At least 68 pipo don kpai and dozens injure afta one Spanish high-speed train jam anoda train for south of di capital Madrid.
Dis na Spain worst rail disaster since 2013.
https://t.co/cfxKki8miq
TUC tell President Bola Tinubu to increase salaries and implement di Joint Health Sector Unions (JOHESU) agreement instead of di 70,000 naira six-month transportation allowance wey Nigeria govment approve for workers.
Full tori: https://t.co/i1nqpgXn9g
Di 2026 Russia-Africa summit bin dey gada delegations from about 48 kontris, including 22 heads of state.
E dey happun three years afta di last summit wey happun for St Petersburg for 2023.
Full tori: https://t.co/XkaGrEIouT
Di transport intervention na for all workers across all levels and e go last for six months and e go start for Novemeber 2026.
Read more: https://t.co/EhkexUFDYK
Authorities say di accused "dey face maximum penalties of 20 years imprisonment for conspiracy to commit mail and wire fraud, 20 years for money laundering, and 10 years for access device fraud, plus mandatory sentence of two years for identity theft."
https://t.co/TW8QSHaOuQ
One foreign national wey attempt to carry bomb enta South Africa through Lebombo port don chop 10 years prison sentence.
Full tori: https://t.co/G43zHnUKTj
Di Independent National Electoral Commission (Inec) through dia tok-tok pesin Mohammed Kudu Haruna say dem go investigate di alleged AI-generated images of voters ontop dia website.
Full tori: https://t.co/juAyU7pU9K
Nigeria govment don find out wetin kpai di 37 pipo wey bin dey for di NSCDC custody for Niger State.
Di Independent Investigative Committee wey chook eyes inside di 37 deaths find out say di alleged illegal miners die of suffocation.
Full tori: https://t.co/LHFhbkjqv7
Dem born Gadi Eisenkot for Tiberias to working-class parents from Morocco.
If e defeat Netanyahu for di election, e go bicom di first Mizrahi prime minister for Israel history.
Read full tori: https://t.co/hLRp6zqq3M
England and Bayern Munich forward Harry Kane don win di 2026 Ballon d'Or award, while Alexia Putellas of Spain win di award for di women category.
Full tori: https://t.co/zfj8HJEx4C
Di 2026 Ballon d'Or award go happun on Monday 26 October, for di London Palladium Theatre wia dem go crown di best footballers wit individual prizes.
https://t.co/zfj8HJDZf4
Di pipo of Kula community for Akuku-Toru Local Govment Area of Rivers State on Thursday 22, carry di five dead bodis wey dem recova from di boat accident wey happun for Robertkiri waterways go Govment House.
Full tori: https://t.co/F2W5w8Km1u
Ogbonge Nigerian actor Francis Duru don die at di age of 57, im family announce on im official Instagram account.
Dis dey come one month afta di death of anoda actor Olu Jacobs.
Full tori: https://t.co/CBNz4UNozF
Ogbonge Ghanaian actor, media personality, comedian and politician Seth Kwame Dzokoto don die.
E die on Wednesday, 22 October, afta e collapse during one live radio show.
Full tori: https://t.co/oGb2icCimi
Chukwuemeka Akagha Dennis tell BBC say im Ebola experience make im mind strong well-well as im no dey fear anytin again.
Dennis believe say if im fit survive Ebola, im go fit survive anytin.
Full tori: https://t.co/6nZNCjcQtE
Police for KwaZulu-Natal Province dey investigate di circumstances around di murder of one foreign citizen, wey dem believe say dey in im his late 30s or early 40s.
Police say one group of pipo allegedly assault am to death on Thursday morning
Full tori: https://t.co/5seK9sA2YF
As e be now, Nigeria health authorities don start to trace di contact of about 44 pipo wey bin get contact wit dis first Ebola case wey don already dey for isolation for one hospital facility for Abuja.
Full tori: https://t.co/P1lxDO7GTq
One South African woman kpai afta shark attack her near di kontri east coast.
Witnesses say di shark bite di 65-year-old for two places and she die bifor dem carry her comot from di water.
Full tori: https://t.co/khsmYjFbge
Di headmaster for di Obuasi Senior High Technical School for di Ashanti Region of Ghana don step aside afta e chop accusation wey involve alleged sexual abuse.
Read more for hia: https://t.co/vV6Zdtgg93
#ghana#obuasi#bbcnewspidgin#ashanti
Wit just less dan three months to di 2027 general elections for Nigeria, di issue of petrol subsidy na still one of di ogbonge issues wey fit determine how di election fit go.
President Tinubu, Atiku, Obi and odas get different positions on fuel subsidy.
https://t.co/maZbppAeok