For anoda separate counts, di first defendant chop accuse say na im provide training and instructions to terrorists and im dey ginger members to commit acts of terrorism through one WhatsApp group titled "The Oneness of Allah is the Foundation of Peace.”
https://t.co/JFoptboUa3
For dia unanimous decision, di Appeal court rule say subsidiary law no go fit disqualify any individual wey di constitution don already qualify.
Na Justice Balkisu Bello Aliyu lead di panel and Justice Eberechi Nyesom-Wike read di lead judgement.
https://t.co/Q4RNkfEXTq
Mary Habila papa and oda family members don carry dia complain go Abuja afta dem no fit get dia daughter deadi body for Ebonyi.
Di papa say dem no dey suspect anybody. Dem just wan bury dia pikin.
Read: https://t.co/nBlm86mTHO
One female TikToker for Ghana don chop one year imprisonment afta she plead guilty to publishing 'abusive and offensive content' against di kontri president and first lady ontop social media.
Full tori: https://t.co/IRdGumNABn
Na at least 20 schoolchildren and one adult die inside one road accident wey happun for Uganda.
According to officials, di accident happun to bus wey bin dey carry pupils for study trip.
Full tori: https://t.co/609DfFAABg
Trump administration don give final notice of plans to implement stricter rules on foreign students, wey include to stop dem from staying for US for more dan four years unless dem get permission from di federal govment.
Full tori: https://t.co/WXu3V6bV0e
Di charges wey dem dey try her for neva dey clear but tori from South Africa say she dey face deportation charges afta allegation say she enta di kontri illegally.
https://t.co/SMMPYXZttm
Di minister Dave Umahi for briefing wit tori pipo for Abuja on Thursday say evidence boku about how Ms. Mary die.
Oga Umahi tok say Mary boyfriend don also reveal wetin e discuss wit di woman before she die.
Full tori: https://t.co/vMHl6Diqyk
Di US House of Representatives don agree to one amendment bill wey go increase withholding of assistance to Nigeria from 50 percent to 100 percent until di West African nation take effective steps to prevent and respond to violence within dia territory.
https://t.co/XBRHLpInMc
Nigeria regulatory agency in-charge of company regulation, Corporate Affairs Commission (CAC) don list 100,000 companies wey dem go comot dia names from dia register.
Full tori: https://t.co/lPiyHDreEC
United States don identify 23 kontris across Africa, Asia and Europe wey dem consider too dangerous for American citizens to visit.
Full list of kontris US Department of State warn dia citizens say make dem no travel to: https://t.co/IqF0NzzxxJ
Govment officials say di death of Bashiru Isak dey linked to di current wave of xenophobic attacks for South Africa even though police for di rainbow kontri say di death dey related to 'extortion".
Full tori: https://t.co/GYTc665cJg
Tori be say di girl do video wia she tok wetin allegedly happun between she and di content creator Odogwu Asaba.
Though police say dem don arrest di content creator, wetin go happun next neva clear.
Read: https://t.co/JXJ1WhHzop
Earlier dis month, dem shoot March and March Gauteng leader Andile Mvuyelwa Somgxada for outside im home on 4 July, few days afta di June 30 protests.
Full tori: https://t.co/ZcsPASYT27
During one raid for Islamabad, di capital, for di end of last month, officials discover 500kg of wetin dem believe to be human placenta for one illegal processing facility.
Wetin dem dey use am do?
Read: https://t.co/NJJJ5reouC
Ova 300 Nigerians don arrive from South Africa sake of di protests against undocumented migrants.
Nigerian govment bin start di repatriation exercise to evacuate dia nationals wey wan comot for SA sake of di anti-immigration wahala for di kontri.
https://t.co/AlJ6LbwjH5
Di outcome of di match between Argentina and England today go determine who go face Spain for di World Cup final.
Di reigning champions go fit play for back-to-back final for di World Cup or England go dash dia hope.
Wetin be your prediction?
Full tori: https://t.co/jwtAl0UjI9
Dis dey follow earlier evacuation of nearly 1,000 pipo from di rainbow kontri for early June, due to xenophobic attacks and harassment against African nationals.
Full tori: https://t.co/ZbGcyHM3i5
Nigerian govment bin start di repatriation exercise to evacuate dia nationals wey wan comot for South Africa sake of di anti-immigration wahala for di kontri.
Full tori: https://t.co/AlJ6LbwjH5
Tori be say na for Osun state, Southwest Nigeria police arrest Prince Adeyemi.
Video wey don go viral show how police dey ask am kwesion afta di arrest wey happun just as Judge issue di order for Abuja today.
Full tori: https://t.co/asG5pVeyMb