Dr Adeda allegedly kpai afta one incident for di Examination and Records Department of di Ministry of Secondary Education.
Tori be say na thugs come beat am afta e get kwanta wit di commissioner of secondary education.
Read more on di tori: https://t.co/ZjHYJeY5tH
President Cyril Ramaphosa don announce four immediate measures to tackle violence against women.
Im announcement dey come afta police discova di deadi bodi of twelve women in and around Ekurhuleni, east of Johannesburg, within just two months.
Full tori: https://t.co/zfHCCzzZ9a
Guinea-Bissau flog Nigeria 3-0 for dia Afcon 2027 qualifiers.
How Nigeria take chop three goals and no score anytin? E dey inside dis match highlight: https://t.co/263zhAUjG6
Gambia press Ghana neck as dem stage epic comeback from 2-0 to win 4-2 against Ghana for dia Afcon 2027 qualifiers.
See how di match take waka: https://t.co/Ofh2Y1hDz2
Guinea Bissau dey sama Nigeria 1-0 for dia Afcon 2027 qualifiers.
Second half go soon start. Nigeria go fit equalise and win di match?
Follow live updates for here: https://t.co/263zhATLQy
Gambia no wan gree for Ghana for dia Afcon 2027 qualifiers as dem play 2-2 for first half.
Second half go soon start. Wetin be your prediction?
Follow live updates for here: https://t.co/Ofh2Y1hDz2
Dem don crown Edward Rukidi Kijanangoma king of Uganda Tooro Kingdom.
For long, di new monarch na familiar face for di East African nation, but many pipo no sabi am as heir to di throne.
Full tori: https://t.co/lpCzCvuAaV
Edo State Special Criminal Court, south-south Nigeria, don sentence four kidnappers for di state to death by hanging.
Dis dey come afta Govnor Monday Okpebholo vow to sign death warrants for criminals wey dem sentence to death for di state.
Full tori: https://t.co/p5C2I3afvv
South Africa President Cyril Ramaphosa go on Tuesday, 29 September address im kontri pipo on top steps im administration dey take to tackle gender-based violence and femicide (GBVF).
Full tori: https://t.co/zfHCCzzrjC
Police for South Africa don discover di bodies of three more women for one area for di east of Johannesburg.
Dis don bring di total number of bodies dem find to 12 in just two months.
Here na di faces of di women as one suspect don kpai: https://t.co/89bo6MkpbR
Suspected bandits don kidnap more dan 60 pipo for separate attacks for northern Nigeria.
Dis na di for di latest wave for di series of kidnappings wey armed criminal gangs don carry out dis year.
Full tori: https://t.co/MDnaglNMcI
Christa Pike, wey dey 50 years now, bin dey 18 wen she and her boyfriend dat time, Tadaryl Shipp, beat, torture and murder Colleen Slemmer, one 19-year-old wey dem bin meet for job training camp for teens wey dey troubled.
Full tori: https://t.co/SpzfiTqahT
Police say dem find di remaining parts of human bodies for inside forest for Abia State.
Police say dem suspect say di bones and skulls belong to pipo wey jaguda pipo kidnap and hide for inside forest for di two locations.
Read full tori: https://t.co/S8Bu07bC5X
Di Independent National Electoral Commission (Inec) for Nigeria go deploy artificial intelligence (AI) to take make sure say wuruwuru no go dey for di kontri general elections wey dey come up for January 2027.
Full tori: https://t.co/DECLfH0bft
Nigeria go face Madagascar for di 2027 Africa Cup of Nations qualifying match wey go happun on Friday.
Di Super Eagles go host di Barea of Madagascar for di Godswill Akpabio Stadium, Uyo, south-south Nigeria.
Wetin be your prediction?
Full tori: https://t.co/nEwG6HYj2u
Anoda batch of 105 Nigerians don return home from South Africa, as concerns dey grow ova di safety of foreign citizens ahead of di 30 September deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to comot for di kontri.
Full tori: https://t.co/0vOVB84hq3
Di hackers, Shiny Hunters, tok say dem get di name, role, badge number and personal details of evri FBI agent, including dia home address, phone numbers and spouse information.
Read full tori: https://t.co/tbmQUdlKym
Di long-awaited boxing clash don land!
Anthony Joshua and Tyson Fury go show face-to-face for one news conference for London on 30 September, as di build-up start to one of di most anticipated fights for British boxing history.
Who go win?
Read More: https://t.co/8ROVS4Tret
US govment don announce new visa restriction policy for foreign citizens wey intentionally travel to di kontri just to born pikin, so dia pikin go be US citizen.
Full tori: https://t.co/tTMrUNlIYr
Di Black Stars of Ghana dey begin dia 2027 Afcon qualifiers wit ogbonge match against Ivory Coast for Thursday.
Wetin be your prediction?
https://t.co/ZiIdHg8QZK