Dapper nor forget na my laho money Dey with me o, u Dey hold me 46 songs royalty income including my “E don cast” money and nor forget too you carry all of us catalog go give virgin u come collect block money, you come pocket am.
You Dey pay 100 lawyers cause you know the kind problem you Dey, and the one I go give you still many well well o, get ready to pay more lawyers, since famous Pluto blow for my hand I don go offline go learn wetin nor Dey my field, I don see how real transparency Dey work, I don see how money Dey flow, but for your hand…. All of us suffer we suffer well well cause you sabi manipulation, na your other name be that, I sha happy say God no Dey sleep, if breeze blow chicken yansh go spread wide open.
“This is an advice and warning to all landlords across the country. Stop renting your properties to churches.They pay better than most tenants but never leave.” — Media Personality Daddy Freeze