Thank God dat I come from a good place. I can never carry shoulder because I already know who I be.
Dem dey count followers.
Me, I dey count peace of mind.
Noise plenty for this life.
But silence get sense.
I don hear crowd shout my name like anthem.
I don still sit alone where everywhere quiet like early morning.
Na for that quiet, I hear my real voice.
Because noise fit make person forget who e be.
Crowd fit hail you today,
Tomorrow dem go ask, โWho be that?โ
Sometimes, the strongest thing you fit do na to step back without explanation.
I no reduce my presence because dem push me out.
I reduce am because my spirit need space to breathe.
Some pple need audience to prove value.
Me, I need calm mind to alwaysย remember my worth.
Me, I choose peace.
I choose mornings without pressure.
I choose nights without performance.
I choose life wey no be competition.
Because when light go off, na your thoughts go follow you sleep.
No be applause. No be hype.
"999"
Go open your eyes.
The Memoir of CharlyBoy.
#coming soon.