Child of God when bad belle people dey conspire against you no worry yourself. Your father dey look dem and in dey laugh.
Their plans no go ever dey successful against you. Amen 🙏
Happy birthday to my Mom 🎂❤️🥳🌹
I love her so much and I pray this year everything changes for the best 🙏
We launched my mom’s palm oil business today that’s her birthday and you should make her oil your household and restaurant plug, the best oil from Bayelsa state.
Pls RT🙏
When last you don look your man give am better compliment? Men also won make their woman tell dem say they look good. Say something nice about his haircut, eyes, six packs or round pack and you go see say in head go dey swell.
If you never get man, tell your brother. No go dey compliment another person man 🫣
Say something dey shine no mean say e be gold and na why Jesus tell us say make we guide against people wey dey pretend to be from God but the truth be say dem dey for themselves.
So no let anybody use bread pack your stew. Shine your eyes wella so you no go fall for their magomago. If you fall for their magomago, dem go deform your heart, guard your heart with everything.