I saw this car online, them write 2,500. I say God don finally remember me.
I carry my last strength go the location. Reach there, I inspect am like say I be mechanic… snap pictures, start am, engine dey purr like small kitten. I even drive am small, everything smooth....no shaking, no sound… na only me dey shake with joy.
My mind say make I no be wicked person, I add extra 500 join....complete 3k. I even dey feel like philanthropist of the year.
Na there the man clear throat…
He say, “boss, no mind that online price… this car na 6.5M.”
For that moment, my soul comot go take fresh air.
I check my pocket, check my life, check my ancestors… nothing balance.
I say “Oga, abeg return my 3k before I start to dey price myself join the car.”
Sha, I collect my money back