Forex Enthusiasm| Lover of Christ| I help struggling traders understand market structures in the most simple way| I'm enthusiastic and passionate about my goals
The Story of an average Nigerian young man!!!
You’ll starve, struggle, stay up late night reading to pass your tests & exams, you’ll do these things for 4-5yrs in the university only to graduate & start looking for job like a mad man.
Not like you ain’t qualified or anything but your papa no sabi anybody, your surname no carry weight.
Life automatically has already given you a tag called “poor Nigerian” now you start shrinking your dreams to fit into your reality, “Omo make I see 50k job first make I use am dey guide for the main time”
Like play like play you go do 2-3yrs on that 50k job, now you’re not your real self you just want to survive, man must wack na abi 🤷♂��
You start planing on getting an apartment cos you need privacy too, you no small again na, frustration every night, thinking on how to make your first million, you start looking 4yrs older than your age, now to visit home sef go be wahala cos Wetin you want carry go home, mumcy go Dey call to pick call sef go weak you cos you no Dey deliver when home call cos kaluba no Dey.
The girl wey you dey date go start dey worry you for iPhone or wig based on she be girl and you no go blame her sha, that one sef go start dey worry you too, you can’t save your salary to get her an iPhone cos you sef na tecno you use and you go starve if you attempt to start saving to buy an iPhone, so you go just chill and while you Dey chill one young boy go activate her release clause and boom you don lose your shenkes.
You no Dey fit sub properly cos Omo data cost, N500 for 2.5gig go become your paddy and you no Dey fit go instagram or TikTok to laugh at least cos data too expensive, so your data na to check livescore to see if your Ekitipin or mr bayo game don boom and to Dey reply WhatsApp messages.
One of your main man don hammer, now him don Dey ball and to pick your call sef na wahala, anyday wey him pick sef him no Dey really tell you wetin you want hear so you vex start Dey learn how to do yahoo by yourself make you for cashout but 3days into it you don lose motivation cos nobi your thing, then you come on twitter you see an account posting $10k floating forex profit on his MT4 ( not knowing say na demo account ) and you’ll be like Omo na forex now oh, you watch YouTube a little then fund your $50 hoping to level up quick so that you go shock that your guy wey don hammer but EURUSD no gree you shine lol 😂.
Konji no Dey gree you rest and you can’t afford to have a girlfriend cos those ones sef na orphans they want be these days and you no get money to Dey take care of another man daughter for now so you go just wait till midnight so that you go do MTN midnight sub, you do it and head straight to pornhub to ease yourself, after that you sleep and next day you head out to your 50k salary job, before you know it you’ve spent 5yrs at the job and mumcy no Dey gree you hear word with marriage lmao 😂.
This is the life of almost 80% Nigerian young men, our saving grace na cos we Dey barb hair 500 or 1k so e no too cost,. We Dey always look clean and presentable but kaluba no too dey.
So my question now is who among y’all stood in line, queued up to get his PVC then decide to vote APC? Who be that F00l? Suffer no Dey tire you? You no get sense? Sha nothing spoil, na who give up fvckup so we steady pushing.
May God favour those he wish to Favour and May his grace be upon those he wish to bless.
Amen.
Peace out ✌️
- Duke Darls
@instablog9ja
@yabaleftonline
@lindaikeji
@FirstBankngr It's so easy for @FirstBankngr to debit but a very huge problem to reverse back. Be the change if you want change in Nigeria. Stop lording over your customers cos small thing you will just lose your work
@FirstBankngr When I say @FirstBankngr Customer service is the worst and most useless set of people, I was correct. Updating your page without attending to your customer's complaints is @FirstBankngr being foolish and wicked. What's stopping you from attending to my complaints via dm? Why?
@FirstBankngr I will keep chanting this;
@FirstBankngr is one of the most useless bank. Poor customer services, they lord over their customer, feel reluctant to address complaint in their dms. Honestly, it's disgusting and tiring. We are already facing a lot pls.