+234 boys too get their own for body, nor be only the girls be the issue.
babe go just dey on her own, una go dm am say una wan appreciate her beauty with hundreds of thousands of naira. who make them believe say them deserve money from men for just being beautiful? lol. biggest enablers of this entitlement culture. funniest thing be say, them go turn around follow men wey no dey move like them, complain for the culture wey they themselves dey fuel, lmao.