As everything na about change, WeRemind sef no carry last.
We don do some kind one or two for our identity.
Wetin una feel about our new face? Dope, abi? Na so!
#Ramadan#Ramadan1445
Assalaamu’alaykum!
Chao don done las las. Alhamdulillah 🥳
If you submit your names, just open this link make you find your own.
https://t.co/T6qc0VUJij
Make Una jolly! 🫡
‘Eid Mubarak!🌙
As team 29 and team 30 dey drag matter since, Sultan don help us settle am with ein announcement.
We pray make Allah accept all our acts of worship from us. Aamin
Taqabbalallahu minnaa wa minkum. 🌹
Make una jolly!
#EidMubarak
No be filter make you fine o, na Allah handwork!🌚
Our Creator, Al-Musawwir na The shaper and Fashioner
E give everybody ein own unique look, style, and identity. No copy anybody, no feel less. You dey perfect as Allah make you!
#Ramadan29
Mighty name, Mighty being, Mighty power, just know say na Allah High pass!
Allah na Al-Muta‘aal (The self-Exalted)
E high pass anytin wey you fit think of. Power, wisdom, honor , nobody fit match am. Even the biggest kings and strongest people still dey under Allah control.
Everybody fit come and go, but Al-Hayy dey there gidigba! 🙌
Na we dey go online and offline(live and die) but you see Allah, na *Al-Hayy (The Ever-Living)
#Ramadanday27
Everybody fit come and go, but Al-Hayy dey there gidigba! 🙌
Na we dey go online and offline(live and die) but you see Allah, na *Al-Hayy (The Ever-Living)
#Ramadanday27
Our God sabiii❕Forget Hyping, Allah Glory na the real deal🙌
You wan dey check am🤔, My Bro, Allah na Al-Majeed (The Most Glorious and Most Noble)
#Ramadan1446#Ramadanday26
Your eye dey see today, but Allah don see tomorrow. So Trust am with your affairs!🙌
Allah na Al-Hakeem The Most Wise😉
Allah no dey make mistake. Every delay, every redirection, and even every ‘no’ na part of ein perfect wisdom💯.
#Ramadan#Ramadanday25
Your matter no big pass Allah, e get space for everybody load!🙌🏽
Bro, no dey stress yourself, Allah na Al-Wasii (The All-Encompassing)
E no dey run out of blessings, and ein mercy no get limit at all.
Just trust Allāh, e go reach your turn na national cake😉
#Ramadanday24
No lose hope guy, Allah no go ever leave your prayers on ‘read’
Our God, Al Mujib na The One Who dey Answer Prayers
If e never happen, no mean say e no go happen.
Keep praying my gee!
Al-Mujib dey listen, and when the time ripe, e go answer you loud!💯
#RamadanDay23#Ramadan
Our Rabb na Al-Ra’uf (The Most Kind and Compassionate)
Allah kindness no get rival! Even when we mess up, ein still dey show us love, still dey bless us, still dey protect us. E no dey quick cast person away, na why we still dey breathe.
#ramadan#ramadanday22
*If to say Allah dey quick judge person, Abeg, who go remain? 😫*
*_Our Rabb🤲 na Al-Haleem (The Most Forbearing)_*
E no dey quick vex, e no dey quick judge person. Even as we dey slip, e still dey wait make we reason and return to am.
#RamadanMubarak#Day21
Our Allah, The real G.O.A.T, If no be by Ein protection, our own don finish o🔥🛡️
Who dey check?
Allah na Al-Hafiz – (The Protector)
Only Him no rival🙌. Guy❕Allah, The Ultimate Protector. E dey protect you from dangers wey you see and the ones wey you no fit see.
#Ramadan
If Al-Ghaniyy no give you, where you wan see am? Yes, You 🫵🏾, Where you wan see that wealth?
You suppose don sabi say Allah na *Al-Ghaniyy (The Richest - free of all wants)
#RamadanMubarak#day19
If God say “e go happen,” who wan say e no go happen?, You dey whine ?😎
Two hands up for only Him🙌, Our Allah na Al-Qadir (The Most Powerful)
You sef know, Power pass power, and na only Allah get am. No situation too hard for am, no matter how e be. E dey #Ramadan#Day18
E get some things wey you go do, if no be say God na Al-Lateef, plenty things go don do you! 😌
God pass man, na why e call himself 👇
AL-LATEEF - (The Most Subtle and Kind)
#RamadanMubarak#Day17
E get sometimes wey you go see God's creations and you go just shout, God dey Create ooo🙌
Fatabaraqallahu Ahsanu-l-khaaliqeen 🥹🙌
Allah na *Al-Khaliq – The Creator
Na ein design this whole universe, balance am well, and still create you in the best way.
#Ramadan#Day16
That good wey you do, no matter how e small reach? E no go ever waste! 🤲💙
Make we explain abi😊
Allah na Ash-Shakur – The Most Appreciative🤲
Even if na small kindness you do, Allah go reward you big. E no dey forget any good act, no matter how tiny.
#RamadanMubarak
*No go dey think say you no fit earn forgiveness, no matter the sin, as far as you repent, Al Ghaffar dey for you* 🤲
Allah na *Al-Ghaffar – The One wey dey forgive back to back.*
#RamadanMubarak#Ramadan#Day14