Becky Lynch vs Charlotte Flair vs Asuka go chook leg put for one bumshot inside triple-threat match for #WWETLC. If #TheMan no win da match, Asuka go win am. Make Charlotte park well fes
Na only Amadioha go save Baron Corbin when Braun Strowman return from hospital con jam him and Lashley and McIntyre for #RAW. Bicos de beat wey Monster Among Men dey plan for dem, e still dey do press up for gym.
#AngryMonster
"The only door you ever knocked down was the door to John Cena's bedroom. And he eventually threw you out of that exact same door."
Chai! @RondaRousey don finish @Nikki Bela sha.
#RAW
Dis @JohnCena new finishing move wey some pipu dey call "6th move of doom" and oda pipu dey call am "lightening fist." Anyway, di way we see am, e be like say na ordinary blow sha. So until dem show us say anada tin involve, na ordinary blow we go call am
#WWE
#DX is back!
But na wetin those old men, Triple H and HBK wan do again sef? And na their fellow Paapa, Undertaker and Kane dem wan fight for #WWECrownJewel sef. Anyway, na hype be sports entertainment business and the hype don dey work already.
#RAW
Wait, so Ronda Rousey nor know say Bella Twins go later fuck her up? Bella Twins wey even fuck demsef up for Royal Rumble, na outsider dem no go kill? Anyway, make she welcome to @WWE#RAW#RondavsNikki
So Kofi Kingston and @XavierWoodsPhD don modify @FinnBalor coup de grace as anada finishing move wey dem take beat The Bar for #WWESSD. Hope say dem go continue with am sha.
My #WWESSD PREDICTIONS
*Becky Lynch to retain vs Charlotte.
*The New Day to retain vs The Bar
*Team Monster win vs The Shield
*Cena/Lashley win vs Owens/Elias
*Samoa Joe win/Draw vs AJ
*Bella/Rousey win vs *Riott Squad
*Triple H win or draw vs Undertaker
Add your own 😂
Arsenal have a lead they don't deserve. Rowe-Smith expending a lot of energy without really doing anything especially defensively. Guendouzi and ElNeny pairing isn't working. Qarabag have played better and don't deserve to be behind.
#EuropaLeague
But dis R-Truth and @CarmellaWWE combination dey make sense o. Jus like dat Carmella don turn to face. Very beautiful sexy face for dat matter. Even me sef don dey like her. Plus her wrestling skills don dey show wella.
#MellaIsMoney#FabulousTruth#SDLive
Oga Perfect 10 wey Randy Orton don break your 10 fingers finish, na now you suppose begin build your legend for @WWE o. By the time everything end, make you don collect United State Champ from Nakamura hand.
#SDLive
Dis @DMcIntyreWWE na anada kind pesin o. De way him dey fight ehn, him suppose win Universal Champion soon. Meanwhile, @RondaRousey need to learn work quick. Her movement nor smooth wella like Charlotte/Becky or Asuka/Sasha. She still get plenty to learn.
#Raw
R-Truth on why him take over Miz TV:
"Two weeks ago I beat you (Miz) in this ring. If you had a championship it would be mine. But instead you have a talk show. So I just took that."
R-Truth don crase kpatakpata 😂
#SDLive
@abuabdallah1277 @iyaboawokoya @MobilePunch Lastly, the report clearly stated that other states have been affected too namely: Delta, Imo, Benue and Rivers. So, unless people saw the headline and started shouting to the heavens without reading through, the report is good. And yes, a reporter can peg a story where he wants
@abuabdallah1277 @iyaboawokoya @MobilePunch Second, the reporter clearly made an attempt to get the government's side of the story by contacting the director of information of the ministry of finance who told the reporter he knows nothing of it. We forget the govt ought to have explained the withdrawal without been told. 2
See as Bayley dey enjoy original hug from Finn Balor. Nor be da cunny-cunny love wey she and Sasha Banks dey form upandan wey tomorrow Banks go still stab her for back. Nansense