There is nobody like our Lord. Not have there been before or will ever be. He’s God all by himself. Nobody fit follow am drag.
And this God come be our father. You see say we don make am 🤗. So see you in church today as we celebrate our awesome father.
Being an olodo is not about not having formal education, it’s about being loud and uninformed.
If person dey intelligent, you will know it by their words and actions.
For some of us we dey situations wey don dey pass wetin we fit handle and if help no come asap, everything fit burst. But I want you to cry to God like David did.
God go bring you out of that situations. That matter no go see ur end but na u go see it end in Jesus name. Amen 🙏
Your body is God’s temple and not something that should be given to people as warmer. Na total disrespect to God be that.
So live with that consciousness and treat your body with dignity and respect for God.
The most important thing wey you ghast do this week na to stand with God & you go see the big big things wey e wan do for your life! No run kiti kata, just stand with God!
Big doors, big opportunities, all those big big things wey go make your life better, God go run am for you!
There’s no love like a father’s love. Love wey dey give everything to make sure say we dey happy and comfortable. Even when everything no dey okay with dem, dey make sure to smile for us.
Papa God go bless and keep you for us. We love you and celebrate you.
In this our generation it’s important to know if the person you call your own also consider you as their own ooo. Make e no be say you dey date yourself.
So to avoid hot tears, no assume for anybody. Ask them, “who am I to you?” Make sure they claim you both in words and actions
My G, I won make u take out time to reminisce about life & e go help you have some perspective. This hustle mood wey u dey do 24/7, u no go take anything with u when leaving oo.
So work but also enjoy urself. Make next of kin no finish wetin u use 50 years work for in 1 year.
Na only God sabi tomorrow, no make plans about your life without involving God.
Carry God along for all your doings and e go better for you and all the things you do.
E fit be say u dey hot before but bcos of some one or two, level no gree level again. I won make you no say things go still sup for you. This is not the end of the book of ur life. The story is still being written.
So no go dey give up. Believe 💪🏽
Some people are professional liars. If dere is a lying competition dey will win comfortably. You no fit trust anything wey come out of dere mouth.
Say the truth, nobody go beat you.
If you want to live soft life, you go need use your head more than your muscle.
I pray for you this week say wisdom and understanding wey you need to scale up in all areas of life God go grant dem unto you.
Happy New Week!
If we talk say make everyone dey list all things wey God don do for them this year, e sure me say we no go fit talk am finish.
So all we have to say is “Thank you Lord”
In every area of leadership wey you find yourself, ensure say you dey make life soft for the people wey you dey lead.
You have a choice to be good to them or make their life miserable, abeg choose to be good. Suffer don tire us
Happy Democracy Day
Omo this glow you are seeing is powerfully sponsored by God. If na by how much I dey make, wahala for dey. 😂
But thanks be to God, wey no put me to shame.
See ehn for you to get something in this life, you go first defeat some principalities and powers. Them go just dey do you wickedness for nothing.
Naa why you have to lock in with prayers so God go touch their heart. E fit be your boss, landlord, lecturer etc.
Make we no lie, money good for body 🥹. You wey say you be introvert if you see money you fit turn extrovert.
I pray say as we dey put in the effort in our work and businesses, we will see good returns to take care of ourselves and family. Amen 🙏
Any difficult situation wey you carry enter this week, God go help you solve am. Weda at work, business or in your family. He will come through for you and you go testify. Amen 🙏
Have a nice week ahead!