if you try calculate time for this lagos, you fit go ment!
always put three hours before your appointment time if you no wan begin tell story of why you come late.
bad as e bad, e better say we late for register than late for posters.
lagos.
#fearlesslagos#lagos
incase you dey wonder why nigerians dey quick rise in rank, na because e don tey wey butterflies understand say, to compete with eagles, dem gats carry fire follow body to fight vipers!
fearless lagos.
#fearlesslagos#streetphotographer
one day, if i no collect beating wotowoto for body, as i too dey like chook camera for person face.
if i no collect, my camera go collect!
una good morning!
fearless lagos,
2022.
#fearlesslagos#streetphotography#fujifilm
nothing wey dodo no fit fix for this country.
infact we suppose crest am for our coat of arms instead of the eagle and horse wey dey there.
since dem born me, i never see eagle koro-koro, even the horse sef, na until i go beach i dey sight am.
#fearlesslagos,
2022.
the things wey dey happen for this country, walahi, e reach to press buhari mumu button, make him pinch russia president, so dat him go vex release satan 2, to scatter nigeria!
nigeria na where suffer-suffer get headquarter!
#fearlesslagos
before uber & bolt enter market, this people do pass idiagbon!
to stop dem na wahala, to negotiate fare with them na double wahala for deady-body. you go even dey beg them join ontop money wey you go pay them.
but today.
fearless lagos,
2021.
#fearlesslagos#streetphotography
i still new for this space, so i go dey struggle small small here, so forgive me.
i be fearless lagos, and i be street photographer wey enjoy pidgin like tomorrow nor dey. if you sabi speak am, abek, speak am; make we for no loss!
fearless lagos,
2021.
#fearlesslagos