FT Scores: England 2 - 1 DR Congo
My people England don commot DR Congo and wetin save England be say Thomas Tuchel study this game or make I say Tuchel get who dey advise am.
England bin need who sabi take on players to break that Congo wall and as Tuchel put Gordon and Saka everything change.
Although dem try but dem no really play anything special in my book na just say dem get striker like Kane wey dey turn up because if to say dem get Ferran Torres as striker dem for lose this game.
Congratulations to England but their midfield lack creativity and all these their pass pass no fit help dem against stronger team wey no dey from 70 mins up.
All these passes wey England dey play no fit help dem..
E good as Tuchel bring on Gordon and Saka because na only players wey fit take on players like Vinicius and Mbappe fit break this Congo wall.
As Saka and Gordon don enter na make dem allow dem play remain.
Today na today.
HT Scores : England 0 - 1 DR Congo
My people by the time wey this DR Congo goalkeeper and Defenders go handle England finish dem go regret why dem allow Congo score first.
Congo don block all di wings and na low block dem dey play, dem just dey play if dem see counter dem go rush am , England sef come dey play high line leave goal come dey keep offside trap for Congo wey no send you.😂
If that Cipenga no commot Spence waist for this match that Bros no go rest, ebi like e want make di werey pay for wetin e do Partey.
Well, England go play tire today, na today dem go know why Eric Chelle cry say DR Congo dey use jAzz play ball.😂
Mistake England do na to allow DR Congo first score dem oo
By the time this Congo goalkeeper and defenders go handle England finish dem go know di difference between Omo and Omo..😂😂
Well, Incase you won w@tch Di match check comment section.
Na all these kind people dey make this work hard for real Ronaldo fans wey know football.
Which one be “Remove their legs” on top sports wey we dey call Football asin Football, Foot oo.
Nawa ohh, find better stats use banter which one be commot their legs.
If you commot their legs where you won put am?
E just be like where you dey argue with rich man pikin you dey tell am “ Commot your papa money I get money pass you”
If na you your papa rich shey you go gree commot di papa money aside ?
Normally Mbappe no dey di same level with any of di players wey dem dey compare am with.
This Mbappe fit create goal from where you think say goal no go come out, tap-ins no dey for hin book.
Put this guy for wing and see wonders, I no just know why some Real Madrid fans begin h@te this guy.
Mbappe is good, big game player wey no dey hide for ball, infact, Mbappe prefer big game than any other match.
Anybody wey hate Mbappe near you abeg help me use left hand give di person better 🫱🏾
I calm down watch all Argentina games for this 2026 Worldcup.
Make I no lie, e go tey before Garnacho go follow Argentina play any tournament.
Unless say this their current coach commot or something happen because Garnacho style of play no just match with this team.
Make e just switch to Ghana.
FT Scores: Brazil 2-1 Japan
Chai, football dey somehow oo, despite di chalk board and di tactics wey Japan carry come this Worldcup dem don still commot for round of 32.
Lowkey I want make Japan reach final but this is football.
Goodbye to them, if their driver sabi dem fit still meet South Africa for road.