All these people wey dey yarn say "Copa America don return to 4 years format"
Dem no know ball at all 😂
@PoojaMedia Make I teach una small:
Copa America don dey 4 years format since 2007 - na the year Messi start o
Messi don play am:
2007, 2011, 2015, 2019.
Yes dem play one for 2016 but na because dem wan celebrate 100 years since 1916-2016. That one na different matter.
After 2019, UEFA and CONMEBOL gree say make Copa and Euro dey play same year.
So dem adjust add one for 2020 but Corona push am go 2021.
The last one na 2024. Count from 2020 to 2024 - na still 4 years.
Copa America na 4 years tournament.
The 2 extra ones na because:
1. 100 years celebration 1916-2016
2. To match Euro calendar so dem fit do Finalissima too.
If you no know, ask before you talk 😌 aka agenda boy's
The day Messi and Antonella start dey age like this 😔
Na that day football don finish o 🥺
From magic to memories.
From Camp Nou to home video.
We dey watch legend fade for real time 💔
Even with the wahala, Messi still come second half for Inter Miami Leagues Cup match 😟
45 minutes, 7.9 rating, 5 shots, 3 on target.
Man try him best to carry the team.
But Miami play rubbish overall, so dem knock out for group stage 💔🇦🇷
Messi no fit do am alone.