Billings no be today, some people no be money dem need! As this lame man for this scripture wan bill Peter, Peter quickly tell am say him be man of modest income but Peter see beyond him billing & he give am wetin fit help am stop dey bill others.
Person bill you no mean say make you rude to them, just tell them respectfully say it didn’t dey. May God keep blessing us all
We wey put our trust in God & not inside the uncertainties of life, nothing fit shake us! Even though we dey this world, our hope dey anchored in God, our solid rock.
Life fit dey confuse you right now and things no just make sense, you even don pray and nothing just gel. Today just come through to God presence with thanksgiving, praise God with all your power.
Your thanksgiving dey about to shift something for your life
Because say Bros J don free you, e don comot the tag of Devil boy boy from our neck & we no be slaves to fear again, so make nobody worry you with these things, standa well well, make dem no try shake you.
The news wey dey street no dey totori anybody, different things just dey happen for our country & honestly e dey worry! But I pray today say God peace wey pass our human understanding go guard us, we no go lose our mind to the craze of the bad news.
#streetchurch#streetbible
Poverty sat you down yesterday but today, you no go see that poverty ever again. Bad days don over for you & better days don show! You dey march into season of surplus! Dey ready to adjust your lifestyle to your new level.
#streetchurch#streetbible#dailydevotional
My G, I hope everything dey alright with you? even if e no dey alright now, every go soon jig.
I hope you dey protect your spirit & you no dey allow any bad energy taint am? Stay well, stay jiggy! Nothing fit run your battery low & you go enjoy the mercies of God