All the things wey God promise you never happen no mean say God don sly you. If Baba God don talk am, den he go do am.
No to worry, no let your mind shake too much, woman wey get belle definitely get due date. Stay God side, no abort your miracle unduly. E go happen for you soonest
I wan make you consider say God get appointed time to blow you up, if you understand our God wella, to rest no go hard you. Him by himself go make your small bigger at the right time.
Take today, thank God for how far & REST!
I pray that in every situation of your life, may you experience God as “Agbanilagbatan” that issue or person wey dey stress ur life, God go deliver you in Jesus name.
We are conquerors through Christ. Amen 🙏
Today na good day to take your problems to God in prayers, to follow God yarn all the things wey dey bother you. We usually dey always project our own behavior to God sometimes & we go think say “my problem too much or my sin too much, I no fit tell God this one” but e no be so.
All the hard guy wey u dey do go melt when u dey in love with the right person. E go be like say dem do u juju. U go just dey fo 😂😂
May we all experience this love. Amen 🙏
You see all the successful people wey you dey admire today, dem no get to that level by mouth. Dem put in hard work and dedication.
So if you want to achieve greatness too, you need to graduate from talking to doing. May we all succeed in Jesus name.
At one point or the other, all of us don chop breakfast. Either for relationship, career, school etc. And the thing dey pain when e happen.
But at dose times, God dey with us encouraging us. If you dey go through any heart break at the moment, God will heal you. 👏🏽