If you manage make am, avoid poor people. The hatred get venom and it can easily kpai you. The level of envious and jealous for this country is too much
โNowadays TikTok makes it a lot easier for people to become artists. You can vibe on TikTok and once it goes viral, they turn it to songs and automatically turn to artists. - Ycee
The level of mindset, I don get be say. Anyone woman at all fit born for me because na me just want the pikin to dey there and I nor really too care about you the mother feelings.
E get the kind of girl wey you go date as a man, your life nor go just stuck one place , all the name of love and insecurity. To do some kind of job to elevate yourself and earn living she go dey see am as a means for you to cheat, omo with those kind of girls, opportunity go pass you by, life go pass you by and when you don finally fall for ground finish, she go come leave you follow another man. Bro to bro wise up
Nigerians say school na scam, no wahala, e sharp like that. But see the society we dey use our hand build today, 10 years old pikin don dey depressed and worry say he never make am.
I just pray make the level of insecurity and unrest for Northern Nigeria nor reach other parts of the country, because na the next line when Nigeria dey go now be that and we all go feel am, one way or the other.
The almighty yahoo nor be like before again, you must be highly smart and get mad update before you fit even see money.
We never talk about the girls children now when don embrace hookup and immorality, enter some TikTok live for 12 a.m make you see the level of useless upbringing when girls dey pass give the upcoming generation, some dey naked and do all
Sort of rubbish only to get coins.
Omo we are in big mess right now and nobody wan address am, we dey even clap ๐ for them.
If you talk, dey go say you when nor guide, you dey envious thatโs why you dey advise who guide pass you.
Even a lot of stupid people still go school and they nor still get sense, in all you do get education not for any person but for yourself and societal reasoning.
Olodo uprising, society wey don loose credibilities and morals, waiting we dey expect to get before? ๐Before Nigerians go know say they get problems the world don move on finish. Society wey dey warship money? this generation dey learn for waiting the upcoming Generation go bring come out, as we dey adore rubbish and avoid accountability, we go always see a lot of gibberish behavior.