Remember when I dey ND for sch then. My bff wey we dey always waka, those cultist dey too eye cos say she get yansh and me dan dey always observe everyday if we dan dey go house. One day as we dey pass she hold my hand as I quickly sight say those cultist dey inside street naso I fling her hand ooo😂😂, even she gan notice. We reach house she dey ask me say why I fling her hand like that, say dem no fit do me anything naw. I reply her say na me you wan koba😂