@instablog9ja Abeg, those wey don pass this stage, how una take calm down and stop thinking like this? Because at this point, na small thing remain make I write my will for Google Docs 😭
@instablog9ja Now my brain don turn Nollywood horror producer: imagining different versions of how I will just mysteriously kpai 😭
One minute I’m fine… Next minute I don plan my own tragic documentary 😭😂
@instablog9ja Abeg elders in the house 😭😂
How una take overcome this level of overthinking?
You go just dey mind your business, next thing you see: “Person died at age 27…” Meanwhile you don dey 26 going 27 like bread wey dey near expiry date 💀