Met this new girl for town, we exchanged contacts started talking, got close. Months later we started dating. We dey go several dates
One day we decide say we no go meet for restaurant again, make we lodge hotel. Me I dey hope say I go finally have my way.
We reach there, order some drinks, we dey vibe well well. I start moving close to her, smooching, from couch to bed. I dey take am slow, no wan rush.
Gbam! As I wan start to take off her clothes, she just say Stop! I dey on my period
Omo my head first scatter! I vex like say I fit tear her slap. Why you con agree to follow me come hotel ?
She say Sorry, I think say we just wan get to know each other more
I reply Wetin we don dey do all these months? You never know me? You agree make I date you, I dey take you out on dates and everything… now you dey talk get to know?
Omo I pursue her comot sharp sharp! I call one of my guys wey I dey run to for normal times to calm me down.
Na so dating be 😂 Wetin una think?