i reconnect with people easily even after years of silence because no friendship of mine is truly broken unless explicitly stated. there will always be a place in my life for everyone i once knew.
You go dress up make you commot, she go come dey make minor adjustments for your face and pick small small things commot from your beards.
You go just dey casually gist am how project wey you dey do dey drain your funds, next thing you don receive heavy alert with caption “my own little contribution, please manage”.
Una go dey waka for public place, next thing she don grab your arm make she dey close to you.
You go commot like this, she go send you text ask you wetin you go like chop before you come back.
You go just dey house like this, next thing she don tie wrapper wey don lose something thickness dey waka for your front dey shake bumbum.