@caro_bolatito @aproko_doctor A friend of mine had similar breakout and she used these below
Retin A cream
Nitrogena ace prone soap
The tablets to take
Collagen
Vit e
Vit c
@the_beardedsina Wen BBC Pidgin visit di hospital on Saturday, we see Peace Marcus wey be mama wey dey on admission with her preterm baby for di Special Care Baby Unit (SCBU).
She say since she don dey on admission for over one month, she never see pikin wey don die and even her baby still dey
@the_beardedsina We get power challenge. Dat no be new tori for Nigeria. Evri wia for Nigeria dey get power challenge but we dey manager am with our generator.
"Di transformer bin get challenge wey we don fix but no day dey pass wey we no dey put on di generator. So no be true," e tok.
@the_beardedsina Prof. Onotai add say even though dem get power challenge, dem get generator back up wey dem dey work with.
"Di pipo wey dey tok dis tin dey tok lie. Na fake news. If na so wia di Mamas of dis pikin dem wey die? Ask dem make dem show you if really e happen.
@the_beardedsina Chairman of di Medical Advisory Committe CMAC UPTH Prof Lucky Onotai tell BBC Pidgin say no pikin die for di unit as im respond to reports wey say some small pikins dem wey dey incubator for di Neo-natal unit of di hospital die sake of lack of power supply.
@the_beardedsina 2 July 2022
Di University of Port Harcourt Teaching Hospital say truth no dey inside tori wey say some pikin wey dey for dia Special Care Baby unit die.