Top Tweets for #DailyScripturalGinger
God pikin, Jesus don talk se mek u wise up, cos we be like sheep weh dey surrounded by wolves. To dey humble no be se u go de mumu yasef. If u no get wisdom, bad pipo go carry u play ping pong.
(c.f Mt 10:16-23)
#DailyScripturalGinger #1040
10.07.26
Di woman with di issue of blood believe se Jesus, go heal am if she touch Jesus. Na so her faith take provoke healing.
No just sidon de doubt. Believe God, put ur faith into action, and ur faith go heal u.
(c.f Mt 9:18-26)
#DailyScripturalGinger #1036
06.07.26
Some of us no go get di kyn opportunity weh Thomas get to touch di risen Christ. But if dem tell u se Jesus na God, u go believe?
Jesus talk se e beta pass for dos weh believe wetin dem hear even tho dem no see am.
(c.f Jn 20:24-29)
#DailyScripturalGinger #1033
03.07.26
"Put mind for good tin,
Commot mind for bad tin;
So dat u sef go dey well,
And Baba God go dey ur side." (Amos 5:14)
#DailyScripturalGinger #1031
01.07.26
Baba God weh save Peter and Paul from prison, na im still allow dem to die for di gospel. E get why.
Las las, di life of a Christian na to glorify God, weda in life or in death.
#SS_Peter_and_Paul
#DailyScripturalGinger #1029
29.06.26
E get as we go love money, power, people, or oursefs pass as we take love Jesus. Anybody weh love anytin pass Jesus no reach to be Jesus disciple. If we put Jesus before any oda tin, Jesus go supply oda tins weh we need.
(c.f Mt 10:37-42)
#DailyScripturalGinger #1027
28.06.26
Just like di leper weh meet Jesus kon tell am "Lord abeg, if u want, u fit make me clean;" we sef gats meet Jesus wit our problem. Jesus get di heart to help us, and e no go shame us if we approach am.
(c.f Mt 8:1-4)
#DailyScripturalGinger #1026
26.06.26
Baba God big pass anything weh de threaten ir life. No give in to fear. Run to God. Baba God no de allow bad tin to near anybody weh run meet am for safety.
(c.f 2 Kgs 19)
#DailyScripturalGinger #1023
23.06.26
If u de look di small fault weh pesin get, but u no de check ursef to see se u de do pass dat pesin, try repent.
(c.f Mt 7:1-5)
#DailyScripturalGinger #1022
22.06.26
No de too worry ursef. If Naba God fit take care of bird weh de fly and flowers weh dey bloom, e go take care of you.
(c.f Mt 6:24-34)
#DailyScripturalGinger #1021
20.06.26
Na for wetin u value na im ur mind go de. If u value God, ur mind go dey where God dey. If u value bad tin, na there ur mind go de.
(c.f Mt 6:21)
#DailyScripturalGinger #1020
19.06.26
Jesus say mek we call Baba God "Our Papa." Dis one mean se Baba God na di Father to everybody. No be only u get di right to call God Papa. Na everybody be children of God. So we gats treat each oda like broda and sista.
(c.f Mt 6:10)
#DailyScripturalGinger #1019
18.06.26
No de do good thing bikos u want mek pipo see u. Spirituality no be by show off. Baba God de see pass that one. E de see de kyn heart weh u get, e de see di good tins weh u de do for secret and e go bless u accordingly.
(c.f Mt 6:1-6)
#DailyScripturalGinger #1018
17.06.26
Commot eye for pesin thing. Before u go begin de think of how to collect am from di owner. Manage wetin u get, before u go turn Ahab weh get plenty vineyard but e still wan collect Naboth own.
(c.f 1 Kgs 22:1-16)
#DailyScripturalGinger #1016
15.06.26
Baba God show us se im love for us too much, so tey upon se we sef be sinners, Jesus Christ still die for us.
(c.f Rom 5:8)
#DailyScripturalGinger
14.06.26
Na love full di heart of Jesus, sotey e no mind to give up im life for us. God is love. Baba God want mek we love as e de love.
(C.f 1 Jn 4)
#FeastOfTheMostSacredHeartOfJesus
#DailyScripturalGinger
12.06.26

Bikos of di good life weh Barnabas live for Antioch, dem talk se "Barnabas na good man weh get di Holy Spirit and strong faith" (Acts 11:24).
Like Barnabas, we sef fit try mek we be good pipo weh get Holy Spirit and strong faith
#FeastOfStBarnabas
#DailyScripturalGinger
11.06.26
"Mek una tek, mek una chop, na my body be dis." (Mk 14:22)
Jesus talk se if we chop im body, we go get eternal life. (c.f Jn 6:51)
E dey invite u, e dey invite me, mek we feast for di banquet weh e set for us.
#CorpusChristi
#DailyScripturalGinger #1007
07.06.26

You claim se u love God, but na bikos of u, anoda pesin de cry. If u like, pray from night till morning, if u de do wicked to pipo, ur prayer na waste. Love of God no complete without love of neighbor.
(c.f Mk 12:28-34)
#DailyScripturalGinger #1005
04.06.26
No be to give Caesar wetin be belong to Caesar. U go remember to give God wetin be God own?
No forget se u sef cari di image of God. U belong God. So u gats give ursef to God.
(c.f Mk 12:13-17)
#DailyScripturalGinger #1003
02.06.26
Last Seen Hashtags on Sotwe
Trends for you
Most Popular Users

Elon Musk 
@elonmusk
240.8M followers

Barack Obama 
@barackobama
119.2M followers

Donald J. Trump 
@realdonaldtrump
111.7M followers

Cristiano Ronaldo 
@cristiano
111.1M followers

Narendra Modi 
@narendramodi
107M followers

Rihanna 
@rihanna
97.8M followers

NASA 
@nasa
92.2M followers

Justin Bieber 
@justinbieber
91M followers

KATY PERRY 
@katyperry
87.9M followers

Taylor Swift 
@taylorswift13
81.8M followers

Lady Gaga 
@ladygaga
73.3M followers

Virat Kohli 
@imvkohli
70.3M followers

Kim Kardashian 
@kimkardashian
69.9M followers

YouTube 
@youtube
68.7M followers

Bill Gates 
@billgates
64M followers

Neymar Jr 
@neymarjr
63.1M followers

The Ellen Show
@theellenshow
62.4M followers

CNN 
@cnn
61.9M followers

Selena Gomez 
@selenagomez
61M followers

X 
@x
60.8M followers
