Top Tweets for #DailyScriptureGinger
As pipo weh no well nid doctor, na so pipo weh no holy nid Jesus.
Nobody de too bad to folo Jesus. Na dos bad pipo Jesus de find mek e help Dem.
So no nid to claim holy. Gree se u no well, Doctor Jesus go arrange ur body wela.
(c.f Lk 5:27-32)
#DailyScriptureGinger #176
17.02.24
If u de fast and u de cheat pipo, u de oppress pipo, u de quarrel, u de cause wahala, u de beat pesin weh no get powa; Baba God no go send dat kyn fasting. E no go answer ur prayer.
(c.f Is 58:1-9)
#DailyScriptureGinger #175
16.02.24
Moses tell Israelite se di choice of life and death de dia front. E remain for dem to choose.
See ehn, if u choose to obey God, u choose life. But if u choose to disobey God, na die be dat.
Choose life! Choose well!
(c.f Deut 30:15-20)
#DailyScriptureGinger #174
15.02.24
My guy,
Joy no de.
Na time to pray, fast, and tear heart for God.
We gats Repent!
We don too mess up but Baba no de quick vex, He too de forgive.
This Lent, na time to fall back on track. No let dis chance pass u.
(Ash Wed. Joel 2:12-18)
#DailyScriptureGinger #173
14.02.24
Upon all u don see, e never clear u se miracle no de taya Jesus?
Abi u don forget d many tyms weh Baba God de come tru?
Even as tinz hard so, Baba stil de run am. Dat one na enof miracle.
Guy! E get notin weh Jesus no fit do.
(c.f Mk 8:14-21)
#DailyScriptureGinger #172
13.02.24
If u plan to do sometin, and e no sup de way u want am, Wetin u go do?
Baba God de tell us se wen u see dis kyn trials, no stop! Go back, rearrange yasef, run am again. Na dis kyn trials go make u wise up when e later click.
(C.f James 1:1-11)
#DailyScriptureGinger #171
12.02.24
E get anytin weh de make u feel se u no clean? Dat tin weh u de hide mek pipo no see. Or dat tin weh no gree u to show face for God side.
My guy, no hide again. Jesus wan make u clean. Just ask am. He go run am sharply.
(Sunday 6 OT, Yr B)
#DailyScriptureGinger #170
11.02.24
As Jesus see as pipo de hungry, na so e multiply food weh de ground mek e reach evribody. E even remain plenty sef.
See ehn, if u notice se pipo de hungry and u feed dem even wit small tin weh u get, food no go finish for ur house.
(Mk 8:1-10)
#DailyScriptureGinger #169
10.02.24
Just becos of her pikin, dat Greek woman leave everytin to find Jesus mek he heal her pikin. She no send, even wen she chop insult join. All na becos of her pikin.
See love nah.
You sef, wetin u fit do mek Jesus epp your pesin.
(Mk 7:24-30)
#DailyScriptureGinger #167
08.02.24
Hypocrite!
Shea u just de talk becos u de do di one weh people de see. Di main tin weh u supos do weh dem no see for eye, u don do am?
No de put mind for small tins weh no mata. Just do wetin de important.
(Mk 7:1-13)
#DailyScriptureGinger #165
06.02.24
All dis suffer weh man de suffer, e no de finish?
Man just de suffer like se God no de.
But even as Job suffer reach, God still help am.
My guy, e never reach to give up. God no de forget im own.
(5th Sun OT Yr B)
#DailyScriptureGinger #163
04.02.24
If God give u anytin weh u ask am, wetin u go ask?
Solomon ask for wisdom mek e use di wisdom handle im pipo mata well.
Shea if dem say mek u ask God, u go ask God for ursef abi u go ask God for wetin go help oda pipo?
(1 Kgs 3:4-13)
#DailyScriptureGinger #162
03.02.24
Evritin weh get begining, get end. Afta evri evri, almighty king David still die. But before e die, e hand ova im kingdom to im pikin. Even if David life no perfect, las las im life end well.
Just pray mek u get happy ending.
(1 Kgs 21-12)
#DailyScriptureGinger #160
01.02.24
Enmity no be good tin. E de destroy plenty families. No mata wat, try reconcile wit ur enemy.
Even as Absalom (David pikin) wan kill David, David weep as Absalom die. Tru Tru, e sweet pass for ur enemy to repent instead of to die.
(2Sam 18)
#DailyScriptureGinger #158
30.01.24
Wen pesin begin to curse u, how u de react? Sometimes e no good to put mind for dos kyn thing. As far as se God de for u, human being tok no important. Learn from David, e no send d person weh de curse am.
(2Sam 16:5-13)
#DailyScriptureGinger #157
29.01.24
Give God full attention. Any oda tin u wan do supos help u focus on God. No gree for any distraction; money, wife/husband, family, work, friends, etc. Mek notin cut ur attention from God. Give am ur all.
(Sunday 4, OT Yr B)
(c.f 1Cor 7:32-35)
#DailyScriptureGinger #156
28.01.24
See as e easy for David to condemn sin. But wen e know se na him de guilty of dat sin, he begin de beg God for forgiveness.
If dem bring ur sin for ur front, u go de humble enof to beg abi u go defend ursef anyhow?
(2Sam 12:1-17)
#DailyScriptureGinger #155
27.01.24
Who be ur mentor?
Who be ur role model?
Who de give u advise?
For Titus and Timothy, na St Paul be their mentor.
Follow person who fit lead u to God.
(Ss Titus and Timothy)
#DailyScriptureGinger #154
26.01.24
Jesus brodas and sistas na dos pipo weh de do di will of God.
Who be ur broda and sista?
Child of God, if ur broda and sista no pass pipo weh be ur blood line, den u no try.
If God na our Papa, all of us na brodas and sistas.
(c.f Mk 3:32-35)
#DailyScriptureGinger #151
24.01.24
See small David, even elders de beg am to be dia King.
Wen God hand de ur head, he go lift u go place weh u no expect. Carry God well mek God follow carry u well.
(2 Sam 5:1-10)
#DailyScriptureGinger #150
23.01.24
Last Seen Hashtags on Sotwe
momson filter:videos
Seen from United States
смотретьгрупповуху
Seen from Philippines
momsonn
Seen from Brazil
一宮市美術作家協会
Seen from Saudi Arabia
mohondoakalianesokkesemifinal
Seen from United States
prayforkatingan
Seen from United States
momsonn() or momson() +filter:native_video #momson
momson(*)***
Seen from Italy
AyMisNalguitas
Seen from United States
たけとんぼ
Seen from Canada
Trends for you
Most Popular Users

Elon Musk 
@elonmusk
241.5M followers

Barack Obama 
@barackobama
119.1M followers

Cristiano Ronaldo 
@cristiano
113.7M followers

Donald J. Trump 
@realdonaldtrump
111.8M followers

Narendra Modi 
@narendramodi
107.2M followers

Rihanna 
@rihanna
98.5M followers

NASA 
@nasa
92.4M followers

Justin Bieber 
@justinbieber
91.7M followers

KATY PERRY 
@katyperry
89.5M followers

Taylor Swift 
@taylorswift13
83.5M followers

Lady Gaga 
@ladygaga
74.9M followers

Virat Kohli 
@imvkohli
72.7M followers

Kim Kardashian 
@kimkardashian
70.7M followers

YouTube 
@youtube
68.8M followers

Neymar Jr 
@neymarjr
65.6M followers

Bill Gates 
@billgates
64.9M followers

Selena Gomez 
@selenagomez
62.6M followers

The Ellen Show
@theellenshow
62.3M followers

CNN 
@cnn
61.8M followers

X 
@x
60.8M followers
