Life no be competition, person fit rise before you no mean say dem better pass you. Everybody time dey different.
So clap for others as you dey prepare to receive your own.
Waka this week with the sure mind say everywhere good for you! Everything dey work in your favour & nothing go stop the good things wey go come your way!
Nothing do you!
For some people the solution to the problems you are having is not to keep pushing, it’s to completely change your location.
So no go dey do agidi for where you suppose don port. Ask God to lead you to know when to fight or flight.
Some people don enter deep trouble bcos dey can’t seem to mind their business. Always putting mouth in matter wey no concern dem.
Abeg stop getting involved in situations wey dem no invite you.
Peace ✌🏽
E get one proverb wey say “if you no do bad thing, you no go dey look your back” this is bcos people that do evil things are always on guard thinking someone is about to attack them.
There’s no gain in being wicked. Instead you no go just get peace of mind. So turn a new leaf.
The days of tears don over, na laugh full your house now! The days wey dem no rate you don over, people go come from far to celebrate you! For you, things don dey better.
Na Jehovah declaration to you dis week be dis, na the new update for your life be dis!
No be say we no sabi say bad belle people dey plan bad things for us but we no send dem bcos we no say “Ko le werk”
So I pray say all the places wey enemies set trap say make u fall, no go work. Amen 🙏
Happy Sunday
Dere is absolutely no one that is like ur baby. She’s unique and precious.
So no go dey compare her with anybody. And ladies, carry ur self with swag because dere is none like you.
Human beings fit promise you heaven and earth but when time come to deliver, dem go disappear. But God no be like that. If he don talk am, den he go do am.
So no look up to any man. Look only unto God and he go come through for you. Amen 🙏
If you don owe dis loan sharks before and they disturb you bcos you couldn’t pay, you will have a glimpse of wetin Christ do for us. He paid it all with his life so we can be free.
And now we celebrate the risen Lord 🕺🏽💃🏽
Thank you Jesus