You suppose give your best while you still get chance. Life na short. You no sabi when the game go finish, when your body go comot from you. No waste am.
Sometimes e good make you waka commot from evri evri, find yourself again till you resemble your true self. E dey important well-well, my dear. No forget say you suppose take care of yourself well-well. You deserve am and e go make you better.