Photocopy no fit ever be like original. So why you come dey run from pillar to post looking for what God fit give you? Nothing wey you get from oda source can outmatch wetin God fit give you.
So stop hustling for the fake. Come to God and get the real thing.
@POSSAP_NGG Good day,
I can tell from experience, tho I did not fall for it. Apparently its really easy to apply for the Tint permit personally, which I already did.
However I need assistance getting it put early as it is still pending under "Secretariat Routing".
My G, I hope everything dey alright with you? even if e no dey alright now, every go soon jig.
I hope u dey protect your spirit & you no dey allow any bad energy taint am? Stay well, stay jiggy! Nothing fit run your battery low & u go dey alright dis remaining days of this year.
E get some kain ways wey we know say no be way wey God clear for us to pass, some kain kurukere movements wey dey sweet but at d end of d road na bad wa
As children of God, we no sopos dey move that way, we ghast ensure say we follow d word of God on every path we wan embark on.
As children of God, we don dey set free by wetin Jesus do ontop cross. But that one no mean say make we come dey do anyhow and misbehave
We don dey with God now, so we suppose dey do things wey please am everyday.
Forget the old stories, something New don come! U dey see am? U dey feel am? Perish the old ideas, old ways, forget about say โNa so e dey always be every timeโ this time different! God don start new thing & our lives wan flourish like never before!
No lose faith, Stay jiggy!
God don give you as human being liberty to think & birth wetin you wan see for your future. Plant today wetin you wan see for your tomorrow.
Na exactly wetin you use your hand plant go โgrowโ, plant wisely!
.
.
#streetchurch#streetbible#dailydevotional
Pressure dey street o! But we know say na through plenty pressure eba dey take form! The pressure wey you dey see now go form you into better shape, e go refine your character and lead you to the point of hope. Pressure dey but e dey build us to last, e no fit off us lai lai!