@vslkemo You went to the wrong event. The people you met there are scammers
I have childhood friends who made their life with forex. No one knows them because they are not influencers. They just make their money and love their life
Visa, Mastercard, Stripe & Coinbase dey plan launch new stablecoin platform
Dem wan use stablecoins do cross-border payments
Dis move show say big financial companies don dey embrace crypto wella, as stablecoin market don pass $325B
#BinanceAfrica#Visa#Mastercard
US Treasury don sanction Nobitex, wey be Iran biggest crypto exchange because say dem dey help Iranian government, IRGC & other sanctioned groups move money & dodge international sanctions. 🇺🇸🇮🇷
#BybitAfrica#BinanceAfrica
Crypto Clarity Act don enter Senate Legislative Calendar, meaning say the bill now fit move go full Senate for consideration. 👀
Dis one na very important step for crypto regulation for inside US.
#CryptoNews#CryptoRegulation#USA#BybitAfrica#BinanceAfrica
Toncoin don dey change name go "Gram"
Dem don talk say GRAM na di new name dem go dey answer onto say na wetin first dey their whitepaper, & di switch go take like 3 weeks before e complete
But di blockchain itself still be TON.
#TON#Gram#BybitAfrica#BinanceAfrica
Tom Lee talk say crypto investors dey vex dey comot market after Mark Cuban sell him Bitcoin. 😳📉
Market sentiment dey shake as big players dey exit.
But Tom Lee still dey positive on top crypto matter
#Bitcoin#CryptoNews#MarketUpdate#BinanceAfrica#BybitAfrica
@X For Africans only... they won't believe this
Follow and stay tuned. I bring current crypto updates in pur local pidgin dialect.
Crypto language doesn't have to be complex. I make it easier and fun to understand & keep up with.
Follow and react to see more...
Wahala dey❗️❗️❗️
@saylor wey be one big btc whale don sell 32 #BTC for $ 2.5 million. Dis go be the first time e go sell since 2022.
Now e get like 843,706 #BTC left.
Wetin this one mean for #BTC?
#BybitAfrica#BinanceAfrica
@Bitwise don buy $20M worth of HYPE in one day
Last week, Bitwise ETF clients buy $41.8M HYPE, while Bitwise don stake a total of $55M HYPE
Anybody wey buy BHYP two weeks ago for don perform pass person wey hold S&P 500 for the last two years
Mad oo🔥
#BybitAfrica#Hyperliquid
Vietnam wan get new law wey go allow small business use digital assets as collateral to borrow money from bank
For now, the matter still dey open make public chook eye and mouth inside
Crypto adoption no be new thing again oo
#CryptoNews#Vietnam#BinanceAfrica#BybitAfrica
@BlackRock don carry 929 BTC and 36,449 ETH put for Coinbase. E be like say dem go still carry more put. This one be say something wan happen be that oo 👀
Shey dem dey plan sell out? Na that one we never sure of oo
#Bitcoin#Ethereum#CryptoNews#BybitAfrica#BinanceAfrica
Binance don talk say non-US users go soon fit trade 7,000+ US stocks & ETFs directly for their platform
Users go fit convert stocks enter digital assets as dem (Binance) wan become app for many financial asset
#BinanceAfrica#CryptoNews#Stocks#ETF