In all your years of doing business or working, na dis week go loud pass bcos you go touch money wey you never touch before. Customers go too rush you. Amen ๐
Happy New Week
All the hard guy wey u dey do go melt when u dey in love with the right person. E go be like say dem do u juju. U go just dey fo ๐๐
May we all experience this love. Amen ๐
My guy, believe! That thing wey dem dey discourage u ontop, e dey ur heart for a reason. Believe say u fit run am under God. If u believe, u go receive all the help & things wey u need to overcome any difficulties. That startup, believe God for am! That baby, believe God for am!
As a child of God, you supposed identify with God true and true. No be the one wey Saturday dem go see you for questionable gathering and Sunday dem go see u for church.
You no fit dey play the two sides. Stand with God.
Happy Sunday!
For those wey dey look to enter relationship, wey dey look to find their own good or wey dey pray make dem find them, God go do am for you! You sef go love!
Soon your story go change & you go enter better relationship wey go give glory to God!
For all of us that are expectant our phone will ring with calls of good news. That email that youโve been expecting will come soon.
Our days go waiting are over in Jesus name. ๐
A person in motion will some day meet their desires but you wey just dey sit down, you go tey for dere.
Letโs work when we should and rest when we should. Balance is the key to success. May God bless our efforts. Amen ๐
If you wonder wetin marry people dey enjoy, na in be this. Whatever success you have when u dey single can be doubled when you marry the right person.
If you are single, begin to prayerfully search for a partner to do life with And God will lead you. ๐
These days scammers are getting smarter and better. And if you no careful you go fall victim. So na why e dey important to always pray to God that he saves you from dere wicked schemes.
I pray say for your business or career, you no go enter dere trap in Jesus name.
Life no be movie wey after the first one, e don finish be that. Itโs a series which means, as season 1 dey end, season 2 dey enter.
So as don u plant for your 1st season, be sure that you go harvest for your 2nd season. No worry, everything go soft last last. Amen ๐
If e sure for you say you go see the goodness of God, I want make you plaster am for your chest. As you dey go about today, declare am say โE sure for meโ
Happy new week
Reman blessed๐
To go far in this life you need mercy ooo. If not you go just dey hustle hustle, nothing go show.
Mercy makes everything easy. As you dey enter church today, make sure to pray for mercy. ๐
If you dey go place wey you no sabi wetin you go do? Turn on google maps so dat you no go miss road.
So also in the journey of life, you need Jesus to guide you so dat you will achieve your purpose. You no fit just dey go through life blindly.
For some of us we dey situations wey don dey pass wetin we fit handle and if help no come asap, everything fit burst. But I want you to cry to God like David did.
God go bring you out of that situations. That matter no go see ur end but na u go see it end in Jesus name. Amen ๐
Your body is Godโs temple and not something that should be given to people as warmer. Na total disrespect to God be that.
So live with that consciousness and treat your body with dignity and respect for God.