Human
Male
Sometimes a woman hater
I don't smoke I don't drink
Idgaf which side you on when it comes to politics
anti LGBTVQK whatever y'all do these days
I dey school for the past three years and i no be student all thanks to wrong friends and false hope from Sportybet. I borrow my guy wey get admission same time as me halfe of my school fee because him spend him own and him parents harsh like mad….
And him papa dey work for the school so him dey press am for the stuff. I use the other half start gambling in hopes of making the money back and na that time i new come twitter so i dey see how pple dey chop money me sef been want chop
I remember na around this period sef nba…
And right my wrongs. So far i never make any meaningful progress but i sure say next yr i go write jamb amd try again for her. Even to type this tin no easy for me cus my hand just dey shake i no know if na guilty abi na fear abi na shame
I know say i dey lost but i dey try find my way. I don commot for night go tie rope for tree before but i just dey there cry think about her still come down the rope still dey there and i dey look am anytime i go holiday because na that night my chapter for end but i dey try live