This morning I went to my farm to observe my yams because I learnt last week wind that blew did havoc.
After observing the destruction I was bitter.
How to get some bamboo sticks to support the broken ones was on my mind so I said make i search the adjacent farm if I can get any..
There's this abandoned pit at the edge of my farm, as I walked passed it something got my attention, lo and behold it was a python as shown in the first pic.
Omorh no dulling as protein dey expensive God provided me with a more nutritious one. Sharply I had to do justice to it.
I quickly sent it's spirit to where it came from and collected the prize which is the flesh for proper pepersoup later in the evening...
Copied!
I had been trying to call a friend of mine for about a week but he didnβt pick up. I tried call again this morning and I was told that he had died a week ago. I was shocked, sad, because now Iβm wondering who will pay back the β¦73,000 he borrowed from me. π
If una really know where some of us dey come from, the kind load wey we dey carry for head, the responsibilities wey dey our neck and how hard e be to reach this level, una no go just open mouth talk some kind things.
Everything no be for social media. Everything no be couch, TV stand and fine room pictures.
Some of us dey sponsor ourselves, support family, pay school fees, take care of parents, settle bills and still dey try build a better life little by little.
The fact say my room never look the way you want am make e look no mean say I no dey make progress.
The things wey matter to me fit no be the things wey matter to you.
Before you judge person from one picture, remember say you no know the full story.
You no know where the person start from, wetin him don pass through, and the sacrifices wey him don make to get where him dey today.
I no dey compete with anybody. I dey move at my own pace, and I thank God for how far I don come.
One love ππ