My friend is bravely battling colorectal cancer. Please keep her in your prayers and kindly support her treatment in any way you can. God bless you as you do so. 🙏❤️ Every prayer and every contribution counts.
@DonBiley@DONJAZZY@Ekitipikin@mrbayoa1
I am protected— my health, my family, my wealth, my peace. No weapon formed against me prospers. Progress is my daily reality. I am closer today than I was yesterday. I release all anxiety about money. Abundance is my birthright and I claim it now. I walk in supernatural favor. The right people, deals, and opportunities find me.
I affirm.
You see all the successful people wey you dey admire today, dem no get to that level by mouth. Dem put in hard work and dedication.
So if you want to achieve greatness too, you need to graduate from talking to doing. May we all succeed in Jesus name.
The message for you today be say “God can be trusted” he no go fail or disappoint you. But if you go put your trust in man, just be ready for gbas gbos.
Who will you trust? God or man?
No time dey wey God leave you, He dey close at every point of your life. No go through life like say you dey waka am alone. God is within your reach, call on am at every turn.
Happy Sunday!
At one point or the other, all of us don chop breakfast. Either for relationship, career, school etc. And the thing dey pain when e happen.
But at dose times, God dey with us encouraging us. If you dey go through any heart break at the moment, God will heal you. 👏🏽
God appeared to Hagar when she dey all alone in the desert and he took care of her troubles. This made her surprise that even in the desert God came through for her and she called him El-Roi the God who sees me.
No matter the situation you dey in, God sees you and e go bring you out of it victoriously. In the remaining days of this month you go experience him as El-Roi in every difficult situation of life.
Wicked people dey dis world that we live in and you no even need offend dem before dem go start dey lay trap for you. But by God’s grace all their evil plans will fail. Amen 🙏
Before u go climb alter go make ur vow, u suppose reason am well. Say this thing wey I dey talk so, I go fit do am? No just go dey recite vows wey u no understand the implication.
Say only what you know that you can keep. Remember that God sef be ur witness. May ur hole be blessed.
Food go too yapa for ur table this week bcos naa God dey prepare ur table. You go get more than enough for urself and even share with others.
You shall not lack any longer In Jesus name. Amen 🙏