Una just dey whine God for this app
Early morning, everybody dey post Good morning, thank God for this and that, but before una sleep, nobody dey pray again oo, nobody dey thank God for a successful day.
Nothing God never see for Nigerians hand😂😂
If I born boy, as he dey turn 5 I go first put men on call make dem help me put am for egede. I no wan hear any yeye story say my Joseph dey turn to Josephine
@official_Gegeh Na only for Naija poor man pikin fit yab rich man pikin, and the rich man pikin go dey vex say, “Why my papa no poor make I hustle this life on my own from street?” 😂💔
Imagine person dey cry because him papa no give am opportunity to suffer. 😭😂