Too much of everything no good, you ghast sabi how to balance things up. Human nature no dey work well with extreme, balance na key.
Because maggi dey make soup sweet no mean say make you pack am full pot or else you go dey risk your health.
A lot of us, the pride wey we get no be say we dey buga people or we dey feel bigger than others but our pride dey for how we dey use logic carry everything for dis world.
Truth be say supernatural go everly be master to logic and e go take humble person to bow to wetin dem no
Children of rich man no dey bother about somethings because dem no say their papa cover them, no need to play kalo kalo because e sure for them say they just need ask and e go sup.
We wey be children of God as well, our father get the whole world for him hand,
Who dey zuzu when God never sign the bill? Who fit yarn & e come to pass unless God authorize am?
Nothing dey outside of God, even though we get our own free will, nothing dey happen without God knowing. Know this & know peace, no enchantment fit sup against your Israel.