last year, when DSS burst one house for my area, dem be 4 guys wey dey stay together. but e get one among them wey dey always put him phone for DND.
as the others don bob comot house through fence, dem call this dnd guy, all the calls just dey drop. e no dey reachable at all. na him DSS hold, dem carry am go HQ.
when this egbon come back after spending one week there, you go think say e dey work for mtn customer care with the way e take dey active to pick calls. if you call am for 7:08 now, e go don pick your call since 7:05.