One large explosion don scata area for Beirut, di Lebanon capital.
Lebanon's Health Minister Hamad Hasan say di explosion don cause "very high number of injuries", acoording to local tori pipo LBC.
Lazarus Chakwera call im victory say, "na win for democracy and justice" even as dem be di second African kontri wey go cancel presidential election on top wuruwuru alias vote rigging.
https://t.co/qhr9GXyb7C
Di rape and killing of one five-year-old girl, Kadijah Saccoh for Sierra Leone don cause shock, anger and ogbonge protests for di kontri, as pipo dey demand for justice.
#JusticeforKadijah
https://t.co/sN4mPyYmNz
Good Morning
Anatory Chayamba na im carry today proverb come.
You sabi wetin e mean?
Drop your own proverb for comment. #FridayThoughts#FridayMotivation
Attackers rape and kill Barakat Bello
Attackers rape and kill Uwavera Omozuwa
Police stray bullet hit and kill Tina Ezekwe
Check di pains Nigerian women dey feel right now💔
https://t.co/y1pDXgDXqq
You don read her tori, now watch wetin Fatimah get to say.
Dis rape survivor wan use her tori take ginger oda victims.
Full gist: https://t.co/7BJi9NUC0X #justiceforvictims#thursdaymorning
'She be 17 going on 18 and bin get many dreams'
Di family of Tina Ezekwe, di 17-year-old wey die after police shoot am for Iyana Oworo area of Lagos Nigeria dey wish to wake up from dis bad dream.
https://t.co/nGFlzwBHc2 #JusticeForTina#wednesdaymorning
See how you, yes you awa audience dey consume news tori as e dey hot.
From Kano to Borno, Lagos to Yaoundé, Accra to Abuja, Port Harcourt to Kumasi, Calabar to Duala, Ekiti to Imo - all di local and world tori dey here: https://t.co/SFAUPHp40o
#waterchallenge#SundayMotivation
Una good Morning! As we dey lockdown, no owanbe for dis Saturday but make we ginger you with dis proverb wey Dici Efe Kelite send.
Wetin dis one mean? You fit drop your own too.
#SaturdayThoughts#SaturdayMotivation
Di burial of di Abba Kyari, di Chief of Staff dey shele right now but di biggest question pipo dey ask be say, ‘why dem no do social distancing?’
Wetin you tink about di mata?
📸: NTA