FGP Lesson
I used to be the type wey go spend my last money just to impress babe.
I go borrow, I go adjust my budget, I go even hide my own needs just to look like big boy for her front.
One day I just sit down and think:
“Who I dey do all this one for?”
That day something change.
I stop using my pocket to buy attention.
Now if I no get, I no get.
I no dey force lifestyle wey no be my level just to hold somebody.
Soft me used to buy love.
Demon me no dey pay for what suppose free.
Tag a soft guy that still dey chase… make him learn.
#FGP
Story Time
I dey one small hangout last weekend.
Music dey loud, people dey outside, drinks dey flow.
One babe just dey eye me from afar.
Later she walk come meet me.
“I’ve been watching you since. You look calm. You no dey do too much.”
I just smile small, nod my head.
We yarn small, laugh small, the vibe dey okay.
Later she talk:
“I dey feel you o. Make we leave this place go somewhere quiet.”
I look her, drink my drink, then talk:
“I dey enjoy the night here.
If you wan stay, stay.
If you wan comot, no force me follow you.”
She look me like say she no expect that answer.
Most guys for don jump already.
She still try small.
“You no dey game?”
I reply am:
“I dey game.
But I no dey run.
If the vibe correct, e go happen natural.
I no dey force anything.”
She later comot with her friends.
I just continue my night.
That’s how e be.
I no dey chase opportunity.
Opportunity suppose find me ready.
Tag a soft guy that still dey chase… make him learn.
If my father didn't make me suffer while I was under is roof, why would I suffer with a so called boyfriend or husband?
Women should learn to have a standard and keep to it
FGP Lesson
Before, if a girl leave my message on delivered for hours,
I go dey check my phone every two minutes.
I go start overthinking: “Did I talk too much? Did I do something wrong?”
Now?
If you leave me on delivered, I leave you on permanent.
I no dey wait for attention wey I fit give myself.
Soft me used to beg for crumbs.
Demon me dey cook full pot and eat alone if necessary.
I no dey force people to choose me.
I just make sure I’m too busy living to notice who no choose me.
Tag a soft guy that still dey chase… make him learn.
#FGP