2025 came with promises I thought would shift everything.
Instead, it humbled me, broke me, and now it’s teaching me how to rebuild.
Still, I’m optimistic. There’s time left on the clock.
And I’m using every week left to build back what I lost piece by piece.
Constant Motion🀄️
That charlatan who call himself a prophet have bought some people's senses. I'm surprised many are clapping for him because he does giveaway. Some so called believers are so cheap.
It's a pity.
GOD, ABEG
God, abeg, hear my cry.
For four years now, I don dey wait for bull run.
Four long years of watching charts dey go up and dey come down.
Four years of buying, holding, selling, and buying again.
I don buy prophetic coins.
I don sell prophetic coins.
I don enter because prophet talk say make I enter,
and I don comot when the prophecy no come to pass.
I confess, Lord, say I don doubt Your prophets and their word.
I don question their visions.
I don even hate on some of them because their prophecies no dey fulfill.
Dem say bull run dey come.
Dem say the time don near.
Dem say 2026 na the year.
But now, Lord, 2026 don almost finish.
God, abeg, when bull run go come?
How long You wan test my faith?
How long I go hold while everybody dey lose hope?
How long I go watch my portfolio move from green to red,
from red to deeper red,
while the bull run wey dem promise still dey somewhere far from me?
Lord, abeg, no let me miss the bull run when e finally come.
No let me sell everything one day before the market decide to fly.
No let four years of waiting end in disappointment.
No let my lack of faith make me abandon the very thing wey I don wait for all these years.
Lord, look upon my bags.
I get $ABEG.
I get $WKC.
I get $MERRYCAT.
I get $REST.
I get $FINU.
I get $OCICAT.
I get $PHT.
I get $SPT
These na the little seeds wey I don plant while I dey wait for the rain.
God, abeg, no let me lose faith now.
Until when shall my faith be tested?
Until I lose all my holdings because I no fit believe again?
If bull run dey come, give me patience to wait.
If the prophets dey right, give me strength to endure.
And if 2026 truly be the year wey dem promise, Lord…
time dey run out.
For I don wait.
I still dey wait.
And hopefully, I go continue to wait.
So, God, abeg.
Remember Your servant when the candles turn green.
Remember those wey hold through the darkness.
Remember those wey believe when everybody else don give up.
And if You dey look for person wey don suffer enough to witness the bull run…
Lord, I dey here.
I have $ABEG.
Now, abeg…
send the bull run🙏🏽
@AgborMoses34@Boygenius_David I wonder to what intent is he posting that he taught angels. How does it edify his followers. Even if he truly taught angels as he claims, some encounters and revelation are for personal consumption. Maturity demands that not every dealing with God is for public.